Saturday, 4 July 2015
Shebi Una Know Say Transplant for Shit dey?
Yes my people, una hear me well. Dem get transplant wey dey transfer shit, popo, nshi from one persin to another. Ayama abi? Hear the full gist first.
The tin be say e get one bad bacteria wey dem dey call C. difficile. E dey kill plenti plenti people every year. Oyibo doctors dem come find out say e get one protein wey dey for where shit dem store inside persin body. This protein dey cure C.difficle. Na im make doctors come begin transplant shit wey good to another persin wey him shit bad make no body die.
Translation: There is a medical procedure known as fecal transplant which involves taking out the faeces gut of a healthy person containing a certain protein and giving to another in other to cure a bacteria known as C.difficile which kills thousands yearly.
Wheew!
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment